19/07/2023
Fellow County people I greet oh!
My fellow tarok people I loyal follow!!
Wetin I wan yarn, na serious something wey don dey give me cos to worry.......
*POLITICS*
Dey tin don dey eat food for my plate.abeg make Una no vex!!!
Na like this we come see the *POLITICS*?
Abeg my name na Ponman I be small pikin but make Una no mind me but make una mind the courage wey I get talk this yarn&make Una fear God join.
• politics na game of interest,heaven no sabi am oh! na for this world him reward & recognition go finish.abeg make we no dey fight each other,na for military regime dem dey plan coup no be for civilian regime abeg .
•make the politics no come spoil for our hands ooh. That time wey you dey use witch hunt,propagandize politicians abeg na you dem dey represent go close to dem criticize dem peacefully them go hear you. You give person power u still want come fight the person collect the same power?bro e no fit walk like that call them back peacefully.
•Instead make u hide for bush the try stone that mantle for your brother head make e fall,abeg come close so that after him the mantle fit fall for your head.life na turn by turn.
• abeg if you na APC,PDP,SDP,APGA,and so have you. abeg make we no dey wash our party dirty clothes for public,our neighbors go laugh us.make our fight be indoor fight like husband and wife fight wey nobody go separate / reconcile dem.abeg.
•If our representatives and party officials no dey do us well.dat stone we dey trow fit make dem lose confidence in us,to whom much is given much is also expected,dem fit trow dat stone back ooh.
• If Mr A get na him luck make Mr B no vex,the tin na after sack.that appointment we go all get am one day,if our turn reach that work we go get am too.voilence no fit give us Unity.
•make we preach togetherness and unity if not one day Ponman fit kill him father,or Ponman father fit disown him son if we continue like this.This politics no go spoil for our hands,this our political parties we no go regret as we join am,this our representatives them go appreciate us some day ,that fight,rivalry,enemity,malice,propaganda,witch-hunting,blackmailings.etc we go stop them..
Na beg i dey beg😭😭😭😭😭
🐅Yenzam Tarok🐅 (Pioneer)
Dizan Ponman samuel
Tarok Tv
Taroh patriotic forum
TAROK SINGLES FORUM.
Pidgin English News
Pidgin / English Dictionary''